
O boy! No time! Wetin you dey look? You never see person wey dey chop akara and bread for road before? Lagos Bobo no mind them, chop your akara and bread na im be our own burger…e be like say na Ajebo sef!! Madam abeg give me that corn for fire and coconut N20 me I be one man show, na so I buy boli the other day, I never chop from morning till night, I just dey hustle. So I say make I buy boli carry go house use palm oil chaw am. Me I be one man show I no get time I get many things to do. As I dey waka go house na so this ice cream man wey won dodge okada man jam me! My boli fall for ground…no even think say I go pick am rain fall everywhere just nyama-yama na so I hold the ice-cream man “oya wetin be your problem? Pay me my money! In-fact na double you go pay na okada I go use go back buy another one. na im the guy start to narrate “bros make I tell you the truth I never sell one ice-cream from morning till now…rain fall na bad market…abi you go take ice-cream? Me-sef I never shop since morning na ice cream I just dey chaw” na so I look the guy e be like say de guy serious o…na so I take six yogurt ice-cream “I just remember say my chikala dey come tomorrow for weekend I carry the ice cream go house. As I dey go house I take the N200 wey I won use buy recharge card I fashi! I go for yello place, na im be one Togo girl by the country side wey dey sell fries,ewa anything wey you won chaw, so I cool down buy phuff-puff, yam-burger, akara, fish, potato. O boy I just won chop everything I con buy one small agege bread join am…I waka reach ma-ma place buy 2pure water join am…I carry five ice-cream put for freezer, no ask me wetin do the other one…I use am go chill with my fries and my pure water, I chop finish na so I crash. Tomorrow na Saturday I no dey go anywhere I dey house, na me be one man show I no dey work for anybody I won stay house tomorrow my chikala dey come O boy! Na faji for me. That tomoro come reach na so I huzle everything wey I won do before 10am I don finish... I Sidon dey wait for amaka Akaka no show! Before I know 7pm don reach so I say make I comot come see you my Lagos Bobo thank God say I see you for road. O boy my corn don finish sef make we buy suya from that aboki make we use am go drink pami for dat local bar…oya lets go!!
No comments:
Post a Comment